Nigerian Village Square Forum "The Square"

Go Back   The Village Square > Town Hall > The Main Square

Comment
 
LinkBack Thread Tools Display Modes
Old Oct 16, 2009 , 10:14 AM   # 1
Default Lamentations in efcc cell!



SONGS FROM EFCC CELL…BY FLY ON THE WALL!
Na jeje I dey go when a fly parched on one of the wall on the EFCC cells yarned me this tory!he talk am say as a young man was driven into the premises in a Ford Escalade SUV,he burst out into song thus
“Daddy…daddy send me a lifeline o!....AAlijanjankijon!(2ce)
“Everybody dey take loans o,Aalijanjannkijon
“Naim I take one billion naira o!...Aalijanjankijon
“EFCC don begin purchoo me o…Aalijanjankijon
“Dadddy,daddy…you dey look me so!Aalijonjonkijon
“Na kasa I dey go o so,Aalijanjankijon!AS A LOVING DADDY,THE LATE BILLIONAIRE,HIMSELF A SONGSTER IN HIS DAYS BURST OUT FROM HEAVEN IN HIS CROACKY VOICE THUS:
“Sonny..sonny,make I no hear am o!...Aalijanjannkijon
“Me wey I dey bailout bankrupt people o!Aalijanjannkijon
“How much I spent from my billions before dem kill me o..Aalijanjankijon
“Sebi I say make una share the wealth o…Aalijanjankijon
“No be you dey ask for DNA o…Aalijanjankijon
“Shey una see your life o..Aalijanjankijon
“Dem no dey spend naira,dollar and pounds for Heaven o,Aalijanjankijon
“Na prayers and saara we dey chop here o..Aalijanjankijon
“Make you kno say o..Aalijanjankijon
“The pilot wey dey drive aeroplane o..Aaalijanjankijon
“E no dey press Horn o..aalijanjankijon
“Abi e wan make Baba God commot for road ne?..Aalijanjankijon
“make una no chop Pizza and coughsyrup for EFCC o..Aalijanjankijon
“Na only wetin other inmates dey chop,n aim make you chop o..AALIJANJANKIIIIJON!!!!!!

agensheku is offline   Reply With Quote
Old Oct 16, 2009 , 02:51 PM   # 1 (permalink)
Default Re: Lamentations in efcc cell!



Na Kola you dey take do yeye so?

Kai mallam! Ka mai da hankalin ka.

Aluta!

G

gwobezentashi is offline  
Digg this Post!Add Post to del.icio.usBookmark Post in TechnoratiFurl this Post!
Reply With Quote
Comment

Bookmarks

Tags
cell, efcc, lamentations

Thread Tools
Display Modes

Posting Rules
You may not post new threads
You may not post replies
You may not post attachments
You may not edit your posts

BB code is On
Smilies are On
[IMG] code is On
HTML code is On
Trackbacks are On
Pingbacks are On
Refbacks are On



All times are GMT +1. The time now is 04:11 AM.

Services : E-mail news | RSS Feeds | Podcasts
Links:   About the NVS | Contact Us | Terms of Use | Privacy & Cookies | Advertise With Us
All Rights Reserved. NigeriaVillageSquare.com





Powered by vBulletin® Version 3.8.4
Copyright ©2000 - 2009, Jelsoft Enterprises Ltd.
SEO by vBSEO 3.3.0
Integrated by BBPixel ©2003-2009, jvbPlugin

Thread powered by GARS 2.1.9 ©2005-2006