 | Your head,4kasile!driver stop! | Your head,4kasile!driver stop! I be funky malam and na small small yaruba i sabi. na one day i wan travel from lagos to shagamu.we enter one commercial bus and the driver kick am,e begin fire moto like no man s business!as he wan enter the Express,na im he put one cassette,tune am loud,na im dat one dey shout ORIE O FOKASILE!ORIE O FOKA SILE!na him i turn to my co-passenger i ask am wetin the music dey talk.e come tell me say @you head,e scatter for ground,shei,your head e scatter for ground!wayooo Alaah.na im i call driver,i say make im stop kiakia.i jump commot i say i no go again with that cab.e say why now?na im i tell am say,we never leave lagos,you don dey reach 120km per hour,on top of it,you cassette begin dey talk of scattered head...me i no wan accident o!my people,e be say like say music don finish for heaven abi which one be O foka sile?make Allah help us o abi if head scatter for ground,she na hospital wey dey perpetual strike go gather am together?    |  Palava Tools | | | | | | | | | Jul 11, 2009
, 04:57 PM
|
#
1 (permalink)
| Join Date: Dec 2005
Location:
Macau
Gender: Female
| Re: Your head,4kasile!driver stop!
Walahi, na real wahala be dat o....orie foka sile..scatter finish, nah who go pack am...so u bin leave da other passengers dem comot...chei, na real palava be dat o __________________ Eni Olorun da Kose Clone >I prefer to be full of God....No Bullshtzing< >We hang the petty thieves and appoint the great ones to Public Office..Aesop< >Ape ko to jeun, ki je baje < >The Price Of Greatness Is Responsibility..Winston Churchill< >“It ain’t so much what people know that hurts them as what they know that ain’t so.”- Artemus Ward < >Although men are accused of not knowing their own weakness, yet perhaps few know their own strength. It is in men as in soils, where sometimes there is a vein of gold which the owner knows not of.< JS |
| | Jul 11, 2009
, 07:19 PM
|
#
2 (permalink)
| Join Date: Feb 2007
Location:
Nigeria
Gender: Male
| Re: Your head,4kasile!driver stop! This ya palava e get as e be. But me I for advice you next time not to comot from motor like that. You for ask driver first which person the music dey refer to. If he say no be you, then you know say trouble no dey. But if he say na you, abeg no wait for am to stop. Jump out of the motor fiam as e dey rush dey go.
Na my advice for you be that. Make you no allow ori e k'o 4ka sile.
__________________ No condition is permanent. Love life, live life and enjoy life. Do not allow your background to keep your back on the ground.
|
| | Jul 11, 2009
, 08:33 PM
|
#
3 (permalink)
| Join Date: Apr 2006
Location:
United-States
Gender: Male
| Re: Your head,4kasile!driver stop! Chei mallam, sorry oo about this ya palava. You too funny.
Next time, if you hear funny Yoruba words make you just jump from the bus as Mikky jaga said! Make you no even wait for bus to stop.
Me self I don suffer for this Lagos. Last week I dey for Lagos International Airport. I dey mind my own business dey read one book wey dey sweet me well well. Come see one Yoruba woman just come behind me like that and she said something like “Ah, o dara bi iwe lo iwe daa”.
Chei, Chineke God! I come run away from there like mad person. Me I no know Yoruba. But “Iwe” in Igbo be anger and when I hear the woman say “iwe” two times for one sentence, I ran. The way I ran self police even think say I thief something.
Even now, I never find Yoruba person wey go translate for English wetin the woman dey talk.
Sorry, mallam. __________________ have you laughed today?
|
| | Jul 11, 2009
, 08:51 PM
|
#
4 (permalink)
| Join Date: May 2007
Location:
Gender: Male
| Re: Your head,4kasile!driver stop! Agens,
Nor be wey I say make I fisit NVS, naim I come see the title of a new palaver.
Naim I come decide to quick quick click on the thread, to read and study the palaver. To find out whether na small palaver, abee na heavy duty palaver, wey I go need to carry go worship mountain    for divine insight, understanding and wisdom. B/4 I go come balance back, much much later, to come deliver the ogbonge solution, wey go dismantle the problem; or help others wey dey face similar palaver.
Nor be eem, I come seeam say, na you Agens dey exhale.
Well, no wahala at all.
MEANWHILE: Make I let you know weteen my people talk about your type of scenario:
My people talk say: Person wey nor go school, wey him hear say person wey go school, don speak oyinbo so tay, and after come add say "who are you". Naim be say: dem don talk say, make him wey nor go school, go ready properly for fight.
As you hear "Who are you music" Ee good as you Ben Johnson, my dear brother
__________________ I have been driven many times to my knees by the overwhelming conviction that I had nowhere else to go. ~Abraham Lincoln |
| | Jul 12, 2009
, 07:49 AM
|
#
5 (permalink)
| Join Date: Jun 2008
Location:
UK
Gender: Female
| Re: Your head,4kasile!driver stop! __________________ "Those who live in glass house should not throw stones"
"The kettle is always quick to call the pot black"
Thousands of candles can be lit from a single candle, and the life of the candle will not be shortened. Happiness never decreases by being shared. --Buddha |
| |  | | Palava Tools | | | | Display Modes | Linear Mode |
Posting Rules
| You may not post new threads You may not post replies You may not post attachments You may not edit your posts HTML code is On | | | All times are GMT +1. The time now is 08:18 AM.
|